This life no balance!
This life no balance! By the time person eyes dun open, the whole world dun enter third lap, dem con classify us as third world country. This life no balance, Kylian Mbappe is just 20 years old and earns £ 1.2 Millions per month, that same age group to which I belong to in my kantry is still waiting for ASUU to call off strike so schools can reopen, the lucky ones dey manage £ 72 (10nk God for our tarty tiri K, iya Basira's amala has suffer). This life no balance, some countries dun commot earth dey go moon, some dey live for the atmosphere sef, my country still dey struggle fill potholes for road. This life no balance, PhD and MSc holders in yankee dey write books, dey work for NASA, in my country PhD holders dey hustle 20K jobs. This life no balance, countries wey we gada get independence dun become importer and exporter, my country dey celebrate inauguration of boreholes. This life no balance, leaders of dem other countries dey give aids to the tunes of billions of...